Pages

Tuesday 26 July 2016

WE GO DECLARE NIGER DELTA REPUBLIC ON AUGUST 1 –MILITANTS


MILITANTS group, wey dem be the Adaka Boro Avengers (ABA) don vow say nothing go stop dem from declaring the Niger Delta Republic on August 1.
Dem statement drop yesterday,and sign by General Ed­mos Ayayeibo, the group say dem don conclude arrangements to make the Niger Delta Republic a reality as dem don order dem people to return home and tell northerners and westerners to commot from the Niger Delta and eastern States sharperly.

Dem still  issue one quit notice to the military and all agencies of the Federal Government to evacuate the Niger Delta States and the eastern parts without delay. Failure to obey the order, dem say go cause total destruction of military personnel and agencies.

The statement say: “We, the Adaka Boro Avengers and all the freedom fighters for the
Niger Delta region don meet and conclusion say we dey declare the Niger Delta Republic three weeks from today. “So by dis notice we dey call on the Nigerian government to commot all military personnel and all government agencies from the Niger Delta, military barracks and personnel.

“We dey use dis notice to call on our  fathers, mothers, brothers and sisters wey dey live for the northern parts of Nigeria to return home immediately. “We dey warn northerners and western­ers to commot from the Niger Delta region sharperly within three weeks from now, for dem own good.

“If dey no gree hear our warning, we go use so many of dem as example for the Niger Delta region on the due date. “We dey tell the Nigerian government say enough is enough and we dey take our independence by force. We get our foreign backers, so we No dey fear the Nigerian government but we ready for total war. “The inhuman treatment wey the Nigerian
government don do us too much and enough is enough. We no fit  withstand the suffering of our Niger Delta pipu. Make dem no take us for fools.”

Niger Delta Avenger (NDA) don dey claim plenty respon­sibility for the blow up of many oil and gas operations for major oil companies for the Niger Delta region, say dem goal of the destruction of oil and gas infrastructure na to actualise the soverign state of Niger Delta. According to the group spokesman Col. Mudoch Agbinibo, the NDA don spread across the Niger Delta to launch dem currency, passport, ruling council, territory and flag. “By October 2016, we go display our currency, flag, passport our ruling council and our territory to the world,” NDA yarn










No comments: