Pages

Friday, 8 July 2016

OLYMPIC TEAM DEY STRANDED FOR USA , WE NO GET MONEY– SIASIA TO BUHARI


Head coach of Nigeria’s U-23 team, Samson Siasia, don yarn President Muhammadu Buhari, to rescue dem, he say “we No fit dey aim for Gold con still dey beg for money.”


The team for dis year Olympic Games, currently dey  training for Atlanta, USA, but Siasia don yarn about some  challenges wey dem dey face. “No be good image to go Olympics while we dey beg for money around, we dey  beg people for money to take care of the Nigerian Olympic team. How we go fit win gold, if we dey beg for money to take
care of our athletes?,”

“We No get money. We dey USA now without any money. Na Big problem.
“No money for our pocket. We No dey get funds from anywhere. “When you get players who no dey motivated and encouraged, you con dey expect make dem perform miracle abi? “We just wan beg President Muhammadu Buhari to come rescue the sports for thecountry as our father and sports-loving President.

“The sports sector don dey die and it is e dey affect the Olympic teams wey don  qualify to represent Nigeria for the Rio Olympics Games, no be only football, but the other (seven) sports wey Nigeria go do inside Rio.



No comments: