Pages

Monday 25 July 2016

DEM DON KIDNAP ONE RCCG PASTOR FOR IKORODU.



One Redeemed Christian Church of God pastor wey dem dey call Bajomo, don enter kidnappers hand as he dey prepare for workers meeting just before the Sunday service for Isawo, Ikorodu, Lagos branch of the church yesterday July 24th.

Church members say Bajomo being dey Inside church before some unidentified pipu come the church as dem pretend to come there for service before dem bring out dem guns and order the pastor make he  follow dem enter their motor.

One member of the church, Williams, wey witnessed the incident say:  “He just dey busy as he dey prepare for the meeting, before dem know, some people come inside as dem dress fine and dey reason dem as members wey come the church for worship. But as dem pull out dem guns, na dat time we know say dem be militants".

Nobody don hear anything from abductors.

No comments: