Pages

Saturday 23 July 2016

FORMER BOLTON /SUNDERLAND MANAGER SAM ALLARDYCE DON BE ENGLAND NEW COACH.


England don get new coach, Sam ALLARDYCE, na him go be the new manager of the
England National football team.
Dem appointed am after days of negotiations with the English FA and dem don  task am to restore the football glory wey been dey associated with the English team as the F.A no want repeatation of the awful show wey happen to dem for the Euro 2016, as dem just commot after Iceland wipe dem 2-1.

"I dey extremely honoured to be the new England manager especially as e be say no be  secret say dis na the role I don dey always want," Allardyce yarn TheFA.com. "For me, na just the best job for English football. I go do everything I fit do to help England do well and
give our nation the success wey our fans deserve.
"Above all, we must make the people and the whole country proud. I know say we get talented, committed players and dis na time for us to deliver."






No comments: