Pages

Sunday 24 July 2016

SOME IKORODU RESIDENTS WEY DEY VEX DON BURN ALIVE ONE NOTORIOUS RAPIST “BADDO”


No be small. Matter dey happen for Abuja town, Ibeshe, Ikorodu as dem be get one very bad and notorious Rapist wey him name na Badoo.

Badoo dey always terrorise the area as he like to dey rape married women, use white handkerchief clean dem private parts before he go pooff dem. Some women wey don escape from him attack confirm say 'Badoo' na real bad guy as he don attack dem before, but dem beg for dem lives. The matta reach high level after Badoo rape one married woman last month, con still pooff her.

The residents for the area been use jazz find am come out from where he dey hide inside uncompleted building inside bush. As dem catch am, Police and the Oba of the town say make dem No pooff am, so dem detain am. Hand finally catch Baddo after he rape one 8 year old girl as one celestial church vigil dey go on, the church members pursue am after one of the members see the victim for ground helpless. Dem finally catch am as he go hide
inside one primary school, the residents give am the beating of him life as he been don dey escape dem since, before dem finally burn am alive.

No comments: