Pages

Monday 25 July 2016

GOBE FOR CHURCH AS MEMBERS PURSUE DEM PASTOR DURING CHURCH SERVICE FOR LAGOS.


Members of CAC for Abule-Ijesha inside Yaba local government, Lagos state yesterday Sunday July 24th, pursue dem pastor Micheal Oni Commot for the church during the service,
onto disagreements of the disbursement of church funds and him monthly salary.
According to one member of the church, he say dem just transfer the pastor come  their
church from Ibadan, and the pastor dey demand for one particular amount of salary, but dem no gree pay am. Dem dey accuse am say he dey  insult dem and dey cause trouble for the church.


"He been don dey give the church problem, as he dey always cause gobe for the church and dey also fight with members, dey insult and raise  bad covenant among members"Badejo Adelu, wey na one member of the church yarn TVC. According to the pastor, the church members no gree submit accounts of the church to am.  "I ask dem say I want see the account of the church and dey fail to tender am. I tell dem say make dem no spend any money without my approval, but dem no gree".

Source: TVC NEWS

No comments: