Monday, 4 July 2016
MAN CITY DON FINAL UNIVEIL PEP GUARDIOLA GIVE FANS.
Na yesterday Man City finally unveil Pep Guardiola give fans as dem new head coach and na 5,800 supporters witness am.
Guardiola yarn say him dey happy as dem unveil am now and he yarn the some strategy wey go make the club dey more successful. Nigerian player Kelechi Iheanacho with
members of City's Women's and Youth teams sef join am for stage.
He yarn say to carry Messi come Manchester City na mission impossible as he knows say na for Barcelona Messi go end him career, but he say he believe in the Manchester City team, plus some new players wey go join the club as the new season go soon start.
He say he hope to achieve wetin him achieve with Barcelona and Bayern Munich for Manchester City becos he know say dis new season go tough wella.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment