Pages

Thursday 28 July 2016

MIKEL DON DENY SAY HIM DONATE $30,000 TO OLYMPIC SQUAD


Mikel Obi don deny the media reports for Naija say he give 30,000 dollars to him team mates for the U23 team.
Na from the team camp for Hyatt Place, the Captain of Team Nigeria to Rio Olympics dey surprised he say: "Na person first yarn me dis unfortunate story as he call me from Nigeria. I think say he dey joke until he send a the link. I no know the source of dis tori wey be say to me, na way divide us as a team.

I feel say the tori wey suppose to dey drop from the media na stories wey go unite the team instead of to divide us. Our target for Rio na to excel, but if dey continue like dis, den I wonder how we go fit dey united." just Dey Wonder why the writer think say the
players dey hungry say dem need him money, Mikel ask say:

"Tell me the players for dis team wey dey and go dey hungry look up to me for survival? Shey na (William) Ekong, (Oghenekaro) Etebo, (Shehu) Abdulahi, (Daniel) Akpeyi, (Kingsley) Madu, (Okechukwu) Azubuike or (Stanley) Amuzie, wey be my team –mates for the Super Eagles, wey I go dey donate give, or other players wey dey run tins abroad and dem dey do well for themselves?

To me, Dis na just mere distraction and e no go help dis team as dem dey go dis major tournament like the Olympics." He say na the media support dem want.

No comments: