Pages

Tuesday 26 July 2016

POST -UTME: UNILAG DON RELEASE ADMISSION GUIDELINES


The University of Lagos on Tuesday don release dem Post-Unified Tertiary
Matriculation Examination admission screening guidelines for the 2016/2017 academic session.

For one statement wey the institution’s Deputy Registrar (Information), Mr Toyin Adebule, issue say online registration for the screening go hold from Aug. 3 to Aug. 24. He say only candidates wey make  the university dem first choice for the 2016 all Computer Based Test mode UTME and come score 200 and above dey eligible for the screening.

The university say candidates must get five credit for only one sitting inside relevant Ordinary Level subjects, including English language and mathematics. The institution yarn say candidates wey no be 16 years of age by Oct. 31 no go dey eligible for screening and no need to apply. “Candidates wey dey awaiting results sef dey eligible to apply for the
screening. “The candidates dem go dey allowed to upload dem results when they don release am and na only if they applied within the specified period.

“Candidates dey advised to check the university website for the specified periods and other details,’’na so  the statement read be."






No comments: