Pages

Wednesday 31 August 2016

CHRIS BROWN DEY UNDER ARREST AFTER HE THREATEN ONE WOMAN WITH GUN.


R&B singer Chris Brown dey under arrest since Tuesday after one woman claim say he
threaten her with gun, Los Angeles police say hours after officers land for the entertainer Los Angeles mansion come show with a search warrant.

The unidentified woman report the early-morning incident to police, she say the 27-year-old Brown point gun to her before she commot from him estate wey dey Los Angeles. Police say “The investigation still. Dey go on, the search warrant still dey under proper conduct and evidence don dey collected,” dem  say dem  I fit comment on whether any weapons dey the house for now, but searching still dey go on.

News wey nack us now dey say dem don bail am, but the remaining tori go soon touch una.

Chris Brown, wetin dey worry U, u No fit stay without controversy in one year? I hope all dis kind matta no for fall ur music career. Remember u be star, and some kids dey look up to u. Cheers.




No comments: