Pages

Friday 5 August 2016

NIGERIA BEAT JAPAN 5-4 FOR DEM FIRST MATCH INSIDE RIO OLYMPICS


After our Nigerian team manage enter Brazil 6 hours before their first match, Nigerian team still beat Japan 5-4 for the match wey get controversy with our National Anthem
The band for Brazil mistakenly play another Anthem for Nigeria Asia up dey with the real Nigerian Anthem. But dat one plus the stress no stop our boys performance against Japan as Oghenekaro Etebo launch the first goal of the match inside 3 mins of the first half.

Oghenekaro still show him ability as he score 4 goals inside the 5 wey Nigeria take beat Japan. The Japan team sef show strong head, as dem try draw the match, but Nigeria win the match 5-4.

Na Oghenekaro be the fitfirst player to score Hat-Rick for the Nigerian team and na him still be the first player to score hat-rick for the Rio 2016 olympics.

I hope say the boys do dey get time to relax now and train more against dem next match. We say congrats to dem. But how the defence plus keeper of the Nigerian team allow 4 goals enter dem? Coach SIASIA need to look into dat department and hold am strong if we wan go far for dis Olympics. 








No comments: