Pages

Friday 26 August 2016

SEE HOW FULANI HERDSMEN ATTACK ENUGU COMMUNITY.


Suspected Fulani herdsmen attack Akagwe Ugwu community for Nkanu West Local Government Area Enugu State on Thursday morning, dem pooff one Catholic Seminarian and wound plenty pipu for the bloody attack. 

According to Eneh Victor Chigozie, who share the foto, the Seminarian just returned from apostolic work. The armed herdsmen just invade the community and start to shoot everybody on sight. The community dey scattered now, but report dey say the youths of Akagwe Ugwu don mobilised demselves and dem dey hot chase of the herdsmen.

The Enugu state commissioner of Police don show for the community. Gov Ifeanyi Ugwuanyi sef don Land for the Community to see wetin really happen and to promise the town pipu say dem go make sure say dem catch the stupid herdsmen wey cause dis kind Gbege.

Na wa O, why dem dis herdsmen still dey do dis kind rubbish wey dem dey do so, wetin dey do dem, why dem dey do dis rubbish, wetin be dem gain? Enuff is Enuff, the government need to do something fast. Na so Boko Haram take use style start O!


No comments: