Pages

Saturday 24 September 2016

ARSENAL 3-0 CHELSEA: GUNNERS WIPE CHELSEA FOR EMIRATE STADIUM.


Alexis Sanchez, Theo Walcott and Mesut Ozil dey onpoint with Arsenal as dem score the goals to help Arsene Wenger side to pick dem fourth consecutive win for Premier League dis season. 

Arsenal maintain dem sharp run of form on Saturday as dem cool down beat Chelsea to gain more confidence as the season dey go. The 3 goals happen for inside first half, Chelsea no get any shot in target or corner kick throughout the first half. The goals dem start to pour in for just 11 minutes of yhe half half through Alexis Sanchez and three minutes later, Theo Walcott and Mesut Ozil make the goals total 3 against Chelsea wey just get 2shots on target with one corner kick throughout 90 mins of play.

No comments: