Pages

Tuesday 25 April 2017

Akelebe gbab Nurse, others wey four-month-old boy inside Kastina.



One 43 -year -old senior nurse with Federal Medical Centre, Katsina dey among the four suspects now inside Katsina police net with connection say dey sale one four -month -old boy . The nurse , Ogugua Okoh, don dey detaintion with the 18 -year old mama of the boy, wey be Ashawo. Na inside Daki Tara Quarters , Katsina she dey stay. Other suspects wey police gbe na Hauwau Ibrahim , 32, of Kofar Kaura , Katsina and Mrs . Grace Ohuhu of Uba -Kala town , Abia State .
The state Police Commissioner , Usman Abdullahi, confirm the matta for Katsina on Monday he yarn  journalists say investigation still dey go on onto the matta. Akelebe gbab the four suspect for criminal conspiracy and human trafficking .
The Akelebe yarn say na early dis year Aisha for the FMC with help of the nurse . Dem tell Aisha say she born dead pikin and say dem don troway the dead baby, na later Aisha hear say she born live baby and the nurse dem sell the pikin for N200 ,000 .00 , of which dem suppose give her fifty thousand naira. She later go gbege the hospital con threaten the nurse to produce her pikin for her . Police come join the matta as the nurse no fit give betta account of the incident .
Police investigation later arrest Mrs . Grace Ohuhu wey buy the baby and Hauwau Ibrahim wey introduced Aishat to the nurse . Dem don already name The boy 'victor' now don dey recovered from Mrs. Ohuhu. Mrs. Ohuhu, for interview with journalists, deny say she buy the baby, she the N50 ,000 . 00 wey she give the nurse na for upkeep of Aisha wey been need help then. The nurse , Ogugua Okoh, say Victor been dey with her for over one month before Mrs. Ohuhu dey introduced to her by one Joy Ihenamere , wey don move unto the matta.


*abeg no be the original foto to the nurse be DAT o... OgbongeYarn *

No comments: