Wednesday, 21 June 2017
BREAKING NEWS: Hand don gbab one Badoo member for Igbogbo, Ikorodu, Lagos.
Hand don gbab one suspected member of the cult group wey dem dey call Badoo, for Igbogbo, Ikorodu, Lagos state early today June 21st.
According to reports, a pipu of the area see one man wey dey semi naked with big one stone for him hand and he dey try burst enter one house for Felefon street, Ayegbami Community, Igbogbo, Ikorodu. The pipu of the area raise beta alarm as dem halla, the suspect run from the compound. Youths for the area give beta pursue as he dey try run to escape. He offer to bribe dem with N5,000 to free am, dey no gree so he change am to N10,000.
Dey catch the suspect one big stone, and the kind tins wey Badoo cult members dey use for dem attack. Na say the CDA Chairman (Baba Awe) and HRM Oba Abdulsemiu Orimadegun Kasali, the Adeboruwa of Igbogbo yarn make dem no pooff the suspect. Dem don hand am to police dem for beta investigation.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment