Friday, 30 June 2017
GIST:Utibe, the boy wey sing Davido song with viral video, mama don pooff
Remember Utibe? The small boy wey sing Davido song "If" for one video wey trend wella, and Davido sef con choose to help the boy, he put am for school and build house for him and he mama. Gist dey now say the boy mama don pooff.
The person wey record the video that time, Sham Rock, yarn say no be only say Utibe don start school for Government Central Primary school Ibeno, Akwa Ibom state but Davido reached out pay for construction of new house for the boy and him family, wey still dey ongoing.
He mama don pooff and we never know the cause.
"Rest in peace UTIBES MUM.. U struggled to live, u where always telling me u want to start business I told u to recover first, now I got a call u are gone so soon, if life was to be sold I will buy some more years for u...I tried to battle with ur health,but my best wasn't good enough, Who will look after utibe and the two younger sisters.. Who will live in the huz we are building for u... I just wish u slept in that huz even for a second.. My heart is heavy. But GOD knows best. Rip ma'am," Sham write for IG.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)


No comments:
Post a Comment