Pages

Wednesday, 28 June 2017

GIST: OGBONGEYARN ON RADIO WITH MC ONETOUCH NEED UNA SPONSORSHIP O!

As e be now, Una #1 Pidgin News wey start with blog as www.ogbongeyarn.blogspot.com don officially dey on Radio with Mysef, Mc ONETOUCH ontop Crown Fm 101.5, Ile-Ife, Osun State Every Thursday from 3:05-4:00pm as e dey hot.

The groove don move from blog to radio now and so far, ogbongeyarn on radio with Mc ONETOUCH don turn household name and strong force ontop Crown Fm. The program on Radio dey fully packed with
1: Daily News Update
2: Sport News
3: Entertainment Gist
4: Top 10 as e dey hot
5: Make we yarn 'dis na the segment wey callers go call in and yarn dem mind onto our special topics dem to jollificate una bodi as e dey hot.
6: Musical Artist Promotions and special Interview.

The program na just one hour show and e make correct sense ontop Crown FM 101.5 and the whole Osun State as e dey hot. Live Streaming go soon start for all other listeners across the globe..yes across the globe, as we get beta viewers always ontop www.ogbongeyarn.blogspot.com from many parts of the world, and na beta outreach for any business to grow and spread enter everywhere as our viewers and listener dey increase everyday.
Ogbongeyarn on Radio dey call Una to come sponsor any of our segments or the full program in general. If you want make your market sell wella, far and wide, no waste time to bring am come ogbongeyarn on Radio for massive awearness.
To sponsor the program call Mc ONETOUCH ontop 07052121985 or call Crown Fm ontop 08122930135.







No comments: