Pages

Wednesday, 21 June 2017

NEWS: Hand don gbab Female kidnapper wey dey collect N500k for job inside Ikorodu.


Hand don touch one female kidnapper for Ikorodu Lagos, na yesterday dem catch her for Ikorodu, Lagos as she dey try to steal one small girl from her mama room.
The pikin mama just enter see the kidnapper dey do some kind incantations ontop her pikin head, na so she raise alarm with beta shouting before pipu gather con catch the woman. After beta beating,The woman confess say na mission she dey and na one man send her, say na N500,000 the man go pay her. She say she dey collect N500k per pikin wey she kidnap. Na small remain pipu for pooff her, but police con save her as dem carry her go police station for more investigation.

No comments: