Pages

Wednesday, 21 June 2017

NEWS: Suspected herdsmen rape, behead one woman for Edo state.


Suspected herdsmen rape and behead one woman wey her name na Margaret Udiamehi for Ekpoma, Esan West local government area of Edo state.
Reports dey say the woman commot from house go farm on Tuesday June 20th. After she dem notice say she never come back to her house, her family members just go find her for farm. Dey later see her bodi wey dem dump for road.
Angry women for the community enter street to protest the continuous attacks by herdsmen.
The women demand say make all herdsmen for the community commot sharperly. Dey say the herdsmsen almost rape one of the women dem before, but she escape as she run from the herdsmen. As dem yarn for the palace of the Onojie of Ekpoma where dem protest go, one of the daughters of the deceased say dem see her mama bodi for ground naked and with no head around 2am yesterday.
To Confirm the incident, the divisional Police Officer for Ekpoma, SP Franklin Akanonu, vow say dem go arrest the suspected herdsmen. He beg the youths of the area make dem no vex to cause any attack, day dem go do the right tin.

No comments: