Wednesday, 21 June 2017
NEWS: Police don arrest female armed robbery suspect for Imo State, dey pooff her partner for gun fight.
Men of the Imo State Police Command don arrest one female member of six-man armed robbery gang on Tuesday.
One suspect wey dey know as 'Wee Wee' pooff for the attack as he dey follow police dey shoot and exchange bullets, four escape as the mata don hot. The female suspect name na Comfort Okon, 28, from Akwa Ibom State and her gang members don rob one location for 7up depot Orlu, Imo State.
Na the pipu of the area raise the alarm wey alert police dem, the gang dem follow police drag as dey just dey shoot anyhow, atlast, four escape, one pooff and dey arrest the woman suspect. To Confirm the incident, the State Commissioner of Police, CP Chris Ezike, say one AK 47 rifle, one motorcycle and money wey reach N193,980 don dey recovered from the gunmen.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)


No comments:
Post a Comment