Pages

Friday, 30 June 2017

SPORT: Cristiano Ronaldo don share the first foto of him new twins wey he get thru surrogate.


Cristiano Ronaldo don finally share one better foto of him twins wey he born thru surrogate mother (meaning say, Ronaldo no sleep with the woman, na him sperm dem inject put for the woman body to carry belle and born for am. Most na contract.)
The 32-year-old footballer  don confirm ontop Facebook yesterday say he dey commot from the FIFA Confederations Cup for Russia to be with him new babies for the first time. He upload the foto thru  Instagram and write say:  "So happy to be able to hold the two new loves of my life."

No comments: