Pages

Thursday 19 July 2018

KAYODE FAYEMI DON COLLECT THE CERTIFICATE OF RETURN FROM INEC.


The Ekiti State Governor-elect, Kayode Fayemi don collect him Certificate of Return from the Independent National Electoral Commission.

The National Commissioner in charge of Oyo, Ekiti and Osun states, Prince Adedeji Soyebi, present the certificate to am for one ceremony wey dey do for the state INEC office for Ado-Ekiti, the state capital. Him running mate, Otunba Bisi Egbeyemi sef don collect him  Certificate of Return too.
After he collect the certificate, Fayemi thank the people for dem support before and during the July 14 governorship election. He promise not to disappoint the people of the state wey give am the mandate for Saturday governorship election.
The Resident Electoral Commissioner, Prof Abdulganiyu Raji, yarn say he dey happy say the election happen upon all the tension for town.

No comments: