Monday, 11 July 2016
ANDY MURRAY DON WIN HIM SECOND WIMBLEDON TITLE AS HE BEAT MILOS RAONIC
Andy Murray don claim him second Wimbledon title with flawless 6-4 7-6(3) 7-6(2) wiping of Canadian Milos Raonic for Southwest London on Sunday July 10th.
Raonic been dey hope to be Canada first grand slam singles champion, but e no easy for am. Yarnings dey after him win, Andy Murray say "dis na the second most important tournament for me every year. I been get some great moments for here and tough losses too, so dat na wetin make am extra special.
I dey proud to lift the trophy with my hands again. Dis Murray win na him third grand slam title and e mean say he don avoid to be the first man to lose for the final of the first three majors of the year for dis professional era -- after he been don succumb to Novak Djokovic for Australia and France.
Raonic, coach wey be John McEnroe, yarn say the defeat go ginger am for next time.
"Andy been don dey play great and he deserves to win here for the second time,".
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment