Pages

Saturday 30 July 2016

FG FALL OUR HAND UNTO UNFILLED PROMISE-STEPHEN KESHI SON


Stephen Keshi Junior, son of former Super Eagles coach, Stephen Keshi, yarn ontop him IG page to express him disappointment with the Federal government unfulfilled
promises to honor him Papa for him Papa funeral rites wey start from Benin city Edo
state on July 28th.
He write say: "I sitdon for front of the federal government ontop national television a few weeks ago and dey promise say dem go honor my Papa the way he deserve. Dey say he don don too much for the country for them not to. Dey make us change dates to fit the Federal governments schedule.

But they no do as dem promise, we no dey mad, or sad, just disappointed, dey suppose dey ashame of themselves. Dis dey send terrible message to our youth wey dey strive to do great things for Nigeria. The good thing na say dem raise us not to ask for handouts. more postponements for dey, today we thank God say the funeral ceremonies begin for Benin, the place wey he love, where him career start. My sisters, brother and I hold am down, with the help of some few others, and now we dey put our Papa to rest. We no owe anyone shit and we fit say dey owe our Papa everything.

No salt, no be the people's fault, we still love Nigeria as Papa too" he yarn.


No comments: