Friday, 8 July 2016
NIGER DELTA AVENGERS NO BE FREEDOM FIGHTER - VP OSINBAJO
The Vice President Yemi Osinbajo don yarn say members of the militant group, Niger Delta Avengers, no be freedom fighters dem be, but people wey dey fight for dem own financial interest.
Osinbajo yarn dis yearnings as he dey deliver the Second Foundation Lecture of Elizade University, Ilaro Ondo state.
“The NDA dem, no be freedom fighters but people wey dey fight for dem private pockets.
The people no dey fight for the development of the region. Dem be economic warriors wey dey fight for dem private pockets. Dem no dey work for the interest of the region. Dem just Dey create more problems for the region with dem activities. Dem just dey pollute the environment and dey make lives more difficult for the people.” na so him yarn
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment