Sunday, 10 July 2016
PORTUGAL BEAT FRANCE 1-0 TO WIN THE EUROS 2016.
No be small matta for the final of the Euros 2016 as plenty drama happen before Portugal finally clinch the cup with 1 goal against host nation, France.
The match been start well as Portugal play 4-4-2 with Ronaldo and Nani to play for front, but Ronaldo con get injury for the first half and na stretcher dem take carry am commot as he dey cry.
The match hot wella as France dey attack Portugal with all dem fire power, as Sissoko play fire for France. The first and second half end 0-0, so dem drag the match enter extra time. As the extra time wan start, Ronaldo come out from the dressing room wey he been dey take treatment to ginger the Portuguese players dem, he even stand for the touch line with the coach as him sef dey give support.
Na substitute player, Eder con score the only goal of the match for inside the second half of extra time. France been play Portugal, as dem get plenty chances to win dem, but luck dey against the French team no be small. Portugal na the underdog for dis competition as e be say dem qualify as best loosers from the group stage. Ronaldo cry turn laugh as he lift the trophy for Portugal.
The French players no fit believe dem eyes as dem sitdon for the field dey cry for front of the home fans. As e be now, Portugal na the Champions of Euros 2016 and na Big achievement for Ronaldo
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment