Friday, 12 August 2016
LIONEL MESSI DON RETURN TO THE ARGENTINA TEAM.
Dis news dey come as good news for Barcelona fans and people wey love Lionel Messi, the player don confirm say him don set to return to the Argentina national team.
Messi don reconsider him decision, after he retire from National football after Chile beat dem for the second time inside the Copa America final wey happen inside USA. Now he want return back to International football. “I see plenty problems for the Argentine football and I no wan create another,” he explain for one statement wey he release on Friday.
“I no want cause any harm, I dey always try to do the opposite and help anytime I fit.
“We must fix plenty things inside the Argentine football, but I prefer to do am from the inside and not to dey criticize from the outside.” “Many things dey run through my
head the day of the last final and I seriously think about quitting, but I love this country and this shirt too much, I thank all the people wey want make i still dey play with Argentina, I hope say we go soon deliver them with some joy.” he yarn.
After much begging for Argentina, both President, Maradona and all the pipu of Brazil, plus fans of Messi fans, he don Change him mind.. I hope say one day, the works go beg me for solutions.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment