Pages

Monday, 11 December 2017

JOIN MC ONETOUCH ON RADIO FOR OGBONGEYARN ON RADIO EVERY FRIDAY


YES MY PIPU! MY PIPU!! MY PIPU!!! na me una Pidgin Ambassador Mc Onetouch aka Mc Ogheneonetouch dey yarn una to listen to the best Pidgin program on Radio OgbongeYarn on RAdio with Me, Myself and I, Mc Onetouch on top Crown 101.5fm, Osun State, from 1:00-1:30pm.

The 30mins program carry beta information, entertainment, gist, jokes and groove to cooley una bodi...
I go dey put the OgbongeNews for una bodi as e dey hot, plus Sport Yarns and Ent. gist, Igostill nack una beta top 5 naija songs a s dey hot!! and you get the chance to join the live program for the segment wey we call make we yarn.. na for dis segment i go open the studio line for callers to call and put mouth for the matter as e dey hot, plus plenty recharge card dey to win for the make we yarn segement
this program full ground to promote any artist from anywhere on air and on the blog... so if u be artsit and u wan promote your music, carry am come Ogbongeyarn on radio, we go promote you everywhere as e dey hot!!!
join mc onetouch every Friday from 1-1:30pm onto crowj 101`.5fm for OgbongeYarn on Radio and your weekend would never remain the same again

ogbongeYarn..una complete spectrum of entertainment as e dey hot!!!

No comments: