Pages

Sunday, 10 July 2016

MOB BUTCHER MAMA OF 7 CHILDREN BECOS SHE DEY PREACH FOR ABUJA.


Some wicked pipu Butcher one woman wey get 7 children becos she dey preach the gospel for one street for Abuja. 

The woman name na  Deaconess Eunice Olawale, we  hear say some unidentified pipu just butcher to death as she dey preach in the morning for Graziano community inside Kubwa satellite town for Bwari council area, Abuja for early morning of July 9th 2016.

Her husband wey dem don marry for 16 years don try Narrate how he take know of her murder, the wey him name na Pastor Elisha Olawale, yarn say  "Two of my sons wey be footballers go field to play ball. Dey just come back to tell me say dem hear say some footballers dey yarn say pipu don butcher one woman wey dey preach the gospel early this morning.



As dem tell me, I trek go the place. As I get there, I no see anybody but I see blood for the ground. I con ask one policeman about the  woman wey pipu butcher to death. He say yes na true and dem don  take her go police station. When we reach the police station, my wife dey the back of the pickup. Dey don commot her head and two legs. We don take her go  mortuary" na so he yarn.

Meanwhile the Abuja police command say dem don dey do some arrest in connection with the murder

No comments: